Hate Versus Dislike

‘Dislike’ and ‘hate’ fit resemble for meaning, the truth be say dem no be the same. Person fit use:

- ‘Hate’ show say him blood hot wella and him fit kill the person or thing wen no sweet am for belle.

- ‘Dislike’ show say sometin no sweet you at all. For dis kind situation, you go just commot yourself from wetin dey happen (the way weh you go take do, every every go notice say wetin dey no sweet you for belle).

Wetin I dey yan be say, ‘hate’ dey carry one kind yeye swag weh dey show say person no send (at all) and kwokwoma no care wether the person kpeme or dey. As the ‘Hate’ matter carry be, people wey go bukuru dey call am “EMOTION”; and dem dey call ‘Dislike’ “FEELING”.

My broda, I don consider the tin wella and me decide say I go just carry myself tie put for LOVE. You dey ask me why? Reason like this now, ‘hate’ na plenty wahala weh person fit carry put for him own head (bros make the tin no kill you o o!).

Abeg, make you no forget say we no be human beings weh dey try get spiritual experience, nbanu, we be spiritual beings weh dey try get human experience.

The tin don finish for my mouth o o o o!

Offences And Forgiveness



Offload the burden of that offense, by forgiving that same person who offended you.

Fear Of Failure



The fear of failure in relationships may just be the instrument you need to guarantee failure in your relationships.

Please Somebody Help!


The Christian And Sin



#SpiritualLive Consider excreta, though generated in a man's belly, it is unwanted and most be passed out. If it is kept in the man's system, it is uncomfortable to the host and makes him sick.

That's the way SIN is in the life of a Christian. If it is not passed out (confessed & turned away from); it sickens the Christian and make it difficult for him/her to maintain a healthy Christian life.